Poem of the day:THE NEWS(NEW LAGOS II)

6 0'clock after my work,
And after the prayer of my neighbour's cock.
Nepa kon bring light,
Light wet dey no bring since last month.
Dey just show light small for us.
Everybody kon dey think sey eno go teyl before dey take am.

But na lie,this evening,
Im  be like sey God talk with dem.
Or may be na the presi yarn dem.
Everybody dey rush; Sam dey rush iron I'm cloth.
Me hold my stand outside for 2 hours,
As I see sey dey no take im ,I kon go inside.

As I siddon on top my tchair,
I kon on my television wey dey.
Deaf and dumb for one month,
Den I come carry the station
Go Hausa tv- 'NTA'-  'taran.......taran!'
Na news time!

Na I'm dey start the talk,
The talk of the news.
And me I no too like news,
But becos I no get beta channel I just dey watch.
Then I kon dey hear yeye matter- Moto jam tailor,tailor jam moto Akara mama throwey.-

But Im be like sey na true talk oo;

"The President of the Federal Republic,
Has considered the complaints of the masses'
Na like so, he dey blow grammar,
Na small small I dey understand.
But the talk wey  he dey talk,
Be like sey he serious well well.

He talk sey the Presi don change things,
He yarn sey,garri don be #150 paint.
Wen I hear first, I off my television,
I go outside go call mama Yemi wey
Dey sell garri and other paddi dem.
Den I kon on the television make dey wetin I here.

As dey siddon one by one,
Dey hear wetin the aboki dey talk.
He talk sey bag of Ofada na #1500,
He talk sey bag of beans na #750.
He talk sey no jamb result to enter university,
Na I'm be sey,Chuks,go go school now- guy no sabi I'm age.

He even talk sey,Presi dey share moto,
He talk sey,you and soldier be the same.
He talk sey we fit follow them talk any how.
He talk sey you fit collect their baby Oyoyo,
And sey notin go fit happen.
He even talk sey you fit dazzle police.

Na im  all of us kon dey look ourself,
'Abi na bicos of dis  thing make light dey ni?
Na Sam dey ask so.
Evry body just lock up
Dey look wetin the aboki go talk again.
Mama Yemi dey eye me sey she no go dey see big gain again.

The aboki they talk go,
He talk sey Olokada* no go work again,
He talk sey Iya alata* no go work again,
He talk sey agbero no go dey again,
He talk sey Olopa no go stay for road again.
Na den I know sey ' Things are turning around for good'.

The aboki no stop oo,
He talk sey,Lagosian fit sleep and wake.
And money go dey enter account,
He talk sey,presi go dey pay us.
He talk sey no down NEPA again;
D tin wey  we don dey expect to hear.

The tins wey  kon spoil matter
Na I'm be sey,
He talk sey nobody wet no fit
Talk sey he wan be Presi.
'Nigeria is treading the path of change',the aboki don talk finish.
Aseh na house of Ajebo I dey watch.

Everybody just dey look me with......
©2017

Comments

Popular Posts